Di Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, don yan warning give landlords wey dey get properties wey dey scatter di original plan of Abuja.
Wike, wey yan dis warning afta him swear in for di State House, also yan say make landowners wey don occupy “green areas” to build properties know say dem go need return those areas.
As him tok dis one, Wike talk say him go get meeting wit staff and directors of di Federal Capital Territory Authority. Him con declare say di time wey dem dey do Land marketing and oda kine corrupt things for di Ministry don end.