Nollywood Actress don enter wahala as dem Sentence am to Six Months for Prison sake of say she break di Currency Act

February 2, 2024

Nigerian actress, Oluwadarasimi Omoseyin, don enter wahala as dem convict am and give am six months imprisonment for spraying and stepping on new Naira notes for one social event for Lagos.

According to EFCC wey talk this one for one statement wey dem post on top their official handle, the actress bin dey arraigned since February 13, 2023, by their Lagos Zonal Command on two-count charges, and she talk say she no do am.

But for the hearing wey happen on Thursday, Omoseyin later change her plea from “not guilty” to “guilty” based on the evidence wey dey against am.

Justice Chukwujekwu Aneke for the Federal High Court for Ikoyi, Lagos, wey preside over the matter, don sentence am to six months imprisonment wey go start from Thursday.

Dem still give her option to pay fine of N300,000 (Three Hundred Thousand Naira) into the consolidated revenue account of the federation.

More Posts