NLC Don Match Leg For Ground Say No Going Back As Protest Wey Dem Wan Do Round We Country Go Start Wednesday.

August 2, 2023

NLC don talk say dem no dey agree with the palliative measures wey President Bola Tinubu announce to help Nigerians manage the wahala wey dey come from petrol subsidy removal. Dem say the APC government plans no dey connect with the true economic situation and the suffer wey poor people dey face right now.

Organized labour don talk say dem go still do their planned nationwide protest wey dey scheduled for today, August 2nd , sake of the petrol subsidy removal. NLC President, Joe Ajaero, wey yan with newsmen say dem still dey plan to protest peacefully from Wednesday, and dem no believe say the President go fit control inflation and fuel prices as dem don unify the exchange rate.

More Posts