NITDA don alert Nigerians about one new banking malware wey dey target users all over di world through advanced phishing attacks.
According to NITDA’s Computer Emergency Readiness and Response Team (CERRT), di new version of Grandoreiro malware na big threat. E dey use advanced methods like screen overlay attacks and remote device control to steal important information like banking details and personal data.
NITDA talk say di malware dey spread mainly through phishing emails and fake websites wey go trick people to download di harmful software wey e go disguise as legit updates or documents.
To reduce di risk, NITDA urge Nigerians make dem dey careful and follow recommended security steps to protect demself.
READ NORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/south-east-south-south-senators-don-talk-say-make-dem-do-beta-consultation-on-the-tax-bill-wey-dey-cause-wahala/