NEC Meeting Go Decide Over Calming Ways, Order States Make Dem Develop Social Registers For The Powerless Nigerians.

July 21, 2023

 The National Executive Council (NEC) don gree to chook mouth for we Naija pipo through one cash transfer programme wey the federal, state and local governments go start sharp-sharp so as to epp reduce the suffering of Naija pipo since dem comot fuel *shock money*. The choice na part of the plan dem reach for the 4th meeting of the Council wey we Vice Presido Kashim Shettima be the oga for the meeting. Our tori-sabi person, Raliat Adenekan con report say the Governor Chukwuma Soludo of Anambra State con dey give newspipo small tok after dea meeting along with Bauchi and Ogun State Governors, Bala Mohammed and Dapo Abiodun , dem tok say NEC raise alarm on top the National Social Register honour wey the before administration bin use, as e tok say dem go relook am for the state level to make sure say the cash transfer reach the most powerless person for we society.

To take answer the high cost of living for we country, the Governor of Bauchi tok say the state governments go share about 252,000 metric tonnes of food wey dem don already plan keep including grains and fertilizers for one small price wey government don already pay part of the money or for no cost at all after dem don receive am from the Central Bank of Nigeria, Federal Ministry of Agriculture and National Emergency Management Agency (NEMA). On Governor of Ogun State, Dapo Abiodun part, e tok say the council don also suggest one six-month cash prize policy for public servants to take reduce dea living and transportation cost while e also dey ginger Governors make dem try reduce the cost of government activities for dea different states.

.

More Posts