National Assembly don yan say them go Finish Electoral Reform before Off-Cycle Elections

January 15, 2025

National Assembly don promise say dem go complete electoral reforms before di off-cycle elections wey go shele dis year.

Senate President, Godswill Akpabio, wey give dis assurance as lawmakers resume plenary, talk say di foundation of any strong democracy na better electoral reforms.

Our tori pesin, Raliat Adenekan, report say di Senate President beg im colleagues for di 10th National Assembly to do di work wey go give Nigerians a system wey go dey transparent, credible, and go show wetin di people really want.

For oda news, di Senate don confirm 34 people to manage di boards of di South East Development Commission and di North West Development Commission.

Dem approve Mark Okoye as di Managing Director for di South East Development Commission, and dem also nod Professor Abdullahi Ma’aji for di same role for di North West Development Commission.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/national-assembly-don-threaten-to-stop-federal-government-allocation-to-jamb/

More Posts