Natasha go serve her suspension as Senate enter recess.

July 25, 2025

Di punishment na based on wetin di Senate Committee wey dey in charge of Ethics, Privileges and Public Petitions recommend, as dem find her guilty after dem investigate complaints wey people raise against her.

Di suspension suppose last reach September 6, 2025. But as Senate don enter recess, di lawmaker wey dey face wahala go serve her suspension during di break.

Akpoti-Uduaghan, wey yarn with journalists on Tuesday after she no fit enter di Senate chamber, talk say wetin Senate do na contempt, and she go carry di mata go court for appeal.

“She say even di suspension from beginning na fraud and the document wey dem take do am get wahala,” she talk.

“She come talk say going forward, she go meet her legal team make dem fit carry di matter go appeal court to get interpretation of wetin just happen. She say she be law-abiding citizen.”

She also accuse Senate President Akpabio say him do pass him power.

As Senate don enter recess, dem no go reconvene until she don serve di full suspension wey Red Chamber give her.

As dem announce di break for Senate floor, Senate President Godswill Akpabio talk say di decision na based on “chamber reciprocity,” say House of Representatives don already go recess according to legislative calendar.

“We don start new calendar wey go carry us reach next year June. So e happen say na now we go take break to fit do major oversights,” Akpabio talk.

He still clear say even though plenary sessions go pause, committee assignments suppose continue during di recess.

“All di necessary committees like the diaspora committee, committee wey dey handle reparation, committee on interior and di rest na now be di correct time for una to go visit prisons and do di other things wey follow.

“Do all una reports and make sure say una submit am sharp-sharp once we come back,” na wetin he direct.

Senate President don urge lawmakers make dem start oversight visits across di country, say their work no suppose stop at all.

“You dey move from plenary for di next few weeks, but you no dey stop your legislative functions, because na wetin your people elect you to do. Members suppose travel go Sokoto, everywhere, to observe di road repairs wey dey happen,” he talk.

“By di time we resume, una suppose bring una reports, committee by committee, make we fit look into am. I dey wish una safe journey and make all of us return in good health,” he add.

Akpabio still inform members about di death of Prof Janet Plang, wey be wife of Senator Diket Plang.

He talk say arrangements don dey for senators to travel go Plateau State on Friday to attend di burial, and one plane don ready to fly from Abuja by 8 o’clock for morning.

More Posts