Naija Federal Government Go Shows Ideas On How Dem Go Take Solve Poverty. 

July 17, 2023

Vice President Kashim Shettima talk say Federal Government go soon show face with one plan wey go address insurgency and poverty, especially for the Northern region.

The VP yan dis one give newsmen wen he go Kano to give condolences to the government and people of the state for the death of Prof. Abubakar Galadanci, one respected leader.

He come talk say President Bola Tinubu dey ready to define the meaning and concept of modern governance and the wahala wey dey happen for the Northwest, wey poverty just dey worsen am.

Shettima add say make we no even think say military fit solve this Northwest crisis, instead, make we use both kinetic and non-kinetic solution. For better understanding, we go need combination of action and strategy, not only military action alone.

More Posts