Mavin Records boss, Don Jazzy, surprise im fans yesterday, as Johnny Drille, don marry.

July 5, 2023

As Don Jazzy dey wish Johnny Drille wife happy birthday, di Nigerian producer and talent manager post foto wey dem take together with di COUPLE on dia wedding day, come put heartwarming caption.

Johnny Drille later confirm di tori with one post wey include clip from im new music video wey im title “The Best Part.”

Di music act don tie di knot with im lover Rima Tahini, wey be di director of A&R for Mavin Global; na di same record label wey im dey signed under.

Months ago, Tahini put video from her wedding for Instagram to mark one year anniversary, but di post no show her husband.

More Posts