Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Wike Don Promise to Arrange Logistics for NNPP Candidate

November 22, 2022

Just like he do for the candidate wey hold the Presidential flag of Labour Party against next year election, Rivers State Governor, Nyesom Wike don put hand for chest talk say hin go provide logistics support for the campaigns of the candidate wey hold the presidential flag of New Nigeria People Party (NNPP) against next year, Rabiu Kwankwaso for round the state.

Wike yarn dis one yesterday when the NNPP flagbearer open the Mgbu-tanwo Inside Roads for the Emohua Local Government Area of Rivers. Wike, one chief of the People Democratic Party (PDP), wey invite Kwankwaso come the event, explain say Kwankwaso na man wey get truth for mouth and hin know say eh mean well for Nigeria. He also talk say Kano dey very important for the victory of PDP for the 2023 presidential election next February.

If we remember, the Rivers governor ginger Kwankwaso make eh no throwey PDP for corner for early March, but enemies for inside the party con finally push am comot. For months, Wike and the four other PDP governors wey call dem self “G5” don order say make PDP fire deir National Chairman, Iyorchia Ayu from office as condition to support the party presidential flagbearer.

Meanwhile, Kwankwsao yesterday, enter hin PDP opponent, Atiku Abubakar as hin talk say any party wey no fit control Lagos, Kano and Rivers states, make eh just forget the 2023 presidential election cause Otilo.

More Posts