Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

LASG Dey Setup Special Hospitals to Reduce Abroad Travel for Health Palava

November 22, 2022

The Lagos State Commissioner for Health, Prof. Akin Abayomi, talk say the state dey set-up special hospitals to reduce pipo wey dey leave country go abroad for better living and better job offering for the health sector.

The commissioner con dey speak for the Doctors for Change (DFC) meeting for weekend for inside Lagos, hin talk say the state don point am say trust, and lack of pipo wey sabi for medical field, be part of the things wey make Nigerians run go abroad for medical care. Abayomi talk say dem wan change am so pipo fit dey run come Naija for medical care. He also talk say the state go continue to dey change good policies wey go attract doctors for the abroad, back to Naija weta na fully or half time.

More Posts