Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

INEC Don Ask Nigerians to Shine eye for This Election

January 10, 2023

The Independent National Electoral Commission (INEC) don ginger Nigerians make dem dey alert, shine dea okpolo eye for the voting areas incase dem see any oyigbo person wey wan dey form Nigerian to take vote for the 2023 general election wey go happen soon.

Na dea National Commissioner for Informat, Festus Okoye, yarn dis matter. Him con stress am again say na only correct Nigerians wey register the right way go fit vote during the election, e also add say dem don put the Nigerian Immigration Service on stand-by to handcuff any person wey dey form Nigerian and get voter card on dat day.

Okoye con dey call Nijans make dem shine dea eye wella and make dem raise alarm if dem see any person wey no be Nigerian for any voting center on Election Day and the security agencies go handle the rest.

More Posts