Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Buhari,Sanwo-Olu Commission Lagos Blue Rail Line

January 25, 2023

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don clap hand give the past and present leaders for the state wey chook hand inside the development of the BLUE LINE RAIL wey the President Muhammadu Buhari go order yesterday.

For the Commissioning, the State Governor talk say the turning point wey dem don achieve na testimony say “the years wey Lagos suffer hardship don over” and e fit only dey swede dey go for every person for the state, and also dem don sign agreement for the making of the second part of the Blue Rail Line. The Governor talk say dem formulate the rail project so e go fit meet the transport needs of the Lagos population wey dey ever rise go, while the transport target for the whole Blue Line Rail na to carry five hundred thousand persons every day as e dey hot.

The Deputy Governor, Obafemi Hamzat, also speak on top the matter, e talk say the transportation plan of Lagos State Government get plenty ways, and e go bring together the different parts of road, rail and water for one smooth way wey go make to dey travel from one place go another place dey sweet person for belle.

More Posts