Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don promise to increase investment in education for the state to ensure say youth get quality education. The Governor, alongside Chief of Staff to the President, Femi Gbajabiamila, inaugurate several projects, including a Conference Centre for Lagos State University, Ojo. Sanwo-Olu talk say e go continue to introduce policies wey go attract investors to tertiary education for di state.
Gbajabiamila, Chief of Staff to the President, talk say di projects wey dem unveil for Lagos na im own way of contributing to education quality, and e call on Nigerians and di political class to always remember di people wey dem dey serve and find ways to improve their lives.
Vice Chancellor of Lagos State University, Professor Ibiyemi Tunji-Bello, thank Gbajabiamila for im donation and ask for support from other well-meaning individuals to make the institution one of di best for Nigeria and Africa. Gbajabiamila also open newly rehabilitated Babs Animashaun road, Sam Shonibare Community development Centre, and a General Hospital, wey dem name after am for Surulere.