Construction giant and contractor of the Second Niger Bridge, JULIUS BERGER, don hand over di multi-billion naira project formally to di Federal Government. Minister of Works, Dave Umahi, yan say e dey satisfied with di project and e confirm say di contractor don fix di vandalized parts. Umahi talk say dem fit hand over di bridge to any private company wey go fit complete all di other roads, collect tolls, and recover investments. E also yan say dem dey work on plans to ease traffic for di old and new bridges during di festive period. Di 1.6 kilometers long bridge connect Anambra and Delta states.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905