Big football club for Italy, AC Milan, don get warning say di new player wey dem sign, Victor Boniface, fit be risky business for summer transfer because of di injury wahala wey don follow am before, as dem dey prepare for new season.
Di Rosonerri don complete di signing of di Nigerian international on top season-long loan from German Bundesliga club Bayer Leverkusen, but one Italian media house wey dem dey call La Gazzetta dello Sport dey doubt di move because of di injury history wey Boniface get.
Gazzetta talk say, “Boniface don dey battle injury for some years now. When e dey play for Bodo/Glimt, him first professional club for Europe, e get two serious cruciate ligament injuries, one for March 2019 and another one for November 2020.”
Dem still talk say di injury wahala continue when e reach Bayer Leverkusen, especially from January 2024, when e no fit play for three months because of adductor injury. Later for November di same year, e miss 12 matches because of thigh problem.
Gazzetta come conclude say, “Whether Boniface go shine for Milan go depend on luck and whether e go fit stay fit.”
Popular Italian journalist Fabrizio Romano post for him X account say, “Victor Boniface agent dey go Italy for talk with AC Milan. Di two clubs don agree for loan move with €30m buy option from Leverkusen.”
Football Italia also report say, “Di deal move forward on Wednesday when Milan drop interest for Manchester United striker Rasmus Hojlund and decide to go for Boniface. Di two clubs don already agree on di transfer plan and fee, and Boniface don give go-ahead to move go San Siro.”
Italian media still dey worry say di 24-year-old don suffer plenty injuries recently and e don do two knee surgeries before 2020.
Last season, Boniface score 11 goals and get one assist for Bundesliga as Leverkusen finish second behind Bayern Munich. In total, e score 32 goals in 61 matches for di club.
Him arrival for San Siro fit help boost Milan attack wey no perform well last season for domestic league.