Israel Yarn Us Say Dea Airstrikes Don Off Two Hamas Officers. 

October 11, 2023

Israeli military talk say dem don kill two top Hamas officials for air strikes for Gaza. Dem talk say Zakaria Abu Muammar and Jawad Abu Shamal, wey dey part of Hamas political bureau, die after dem launch attack for Khan Yunis this morning. IDF talk say Shamal bin dey control Hamas economy and e bin dey involved for funding terrorism both for “Gaza Strip” and outside. Dem still talk say e bin dey lead operations wey dey target Israeli people. IDF yan say Muammar bin be head for Hamas international relations office and e bin dey involved for planning “numerous terrorist activities.” But Hamas never confirm di death of these two men.

More Posts