High Commission of Canada for Nigeria talk say, visa application centres for Abuja and Lagos still dey open to di public.

November 10, 2023

High Commission of Canada for Nigeria talk say, despite di fire wey happun for their office for Abuja, di visa application centres for Abuja and Lagos still dey open to di public. Mr. Demilade Kosemani, wey be Communications and Public Affairs Officer, yan dis one for statement. Two people die and two others wound for di fire and explosion wey happun for Canadian High Commission office for Abuja on Monday. Global Affairs Canada talk say dem go work with local authorities find out wetin cause di explosion.

More Posts