NFF Don Scatter! Gusau And Executive Members Drop Position Sharp Sharp

August 27, 2026

Big gbege don burst for Nigeria football as Nigeria Football Federation (NFF) President, Ibrahim Gusau, don step down from im position.

Gusau announce im resignation on Thursday during one press conference for Abuja, and according to Super Eagles news handle for X (@SSE_NGA), several members of the NFF Executive Committee follow am waka comot too.

This shocking development come after plenty football wahala wey don dey shake the federation.

The biggest blow na when Super Falcons fail to qualify for the 2027 FIFA Women’s World Cup after South Africa beat dem 2-1 for playoff match. Na the first time for history Nigeria women team no go make World Cup.

As if dat one no do, Cameroon still knock Falcons comot from WAFCON for quarter-final stage, while Super Eagles sef fail qualify for the 2026 FIFA World Cup.

Apart from poor results for pitch, NFF don dey face serious questions over how dem take handle the ₦17 billion Federal Government intervention fund wey government release for 2024.

One fact-finding committee report even allege say some board members and officials dey influence invitation of players into national teams just to chop money.

Gusau resignation come just weeks before NFF elective congress wey dem schedule for September 27 for Lafia, Nasarawa State.

As e stand now, Nigerian football fans dey wait to know who go take over the federation as the leadership crisis dey unfold.

FOR MORE TORI

More Posts