Ex-CBN governor, Godwin Emefiele, don talk say di tori wey dem yan say e steal money and do corrupt tins no true. E yan say na to spoil im name dem dey try. E tok say dem even get approval for di Naira redesign wey dem talk say dey controversial. Emefiele say no know about $6.23 million wey dem yan say e withdraw based on fake order, and e deny say e get hand for opening 593 foreign accounts. E still talk say make dem investigate well, and if dem no do am, e go carry di mata go court.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905