Ministry of Foreign Affairs East and Central African Division for Abuja don yan NEMA and oda related agencies plus Nigerian people say wahala fit dey as flood wan show face for di next few days. Dem talk dis one based on sey Cameroon wan release water from Lagdo Dam go Benue River. Dem yan dis tori for one statement wey di Director of African Affairs, Ambassador Umar Salisu sign. E bin get message from di High Commission of Cameroon wey concern di opening of Lagdo Dam sake of heavy rain wey fall for di Northern Cameroon area wey dey close to di dam.
According to National Emergency Management Agency people, about 11 states wey include Adamawa, Taraba, Benue, Nasarawa, Kogi, Anambra, Edo, Delta, Bayelsa, Rivers, and Cross River fit feel di wahala wen dem open di dam. Dem dey tell people wey dey dat side say make dem commot from di area make wahala no touch human beings and property wey get value.