Minister of Water Resources, Suleiman Adamu don carry blame give state governments for not hearing all the early warnings wey for don help block the impact of the floods wey happen dis year.
For the Federal Executive Council (FEC) meeting yesterday, Adamu, tok am say e no get as dem wan take stop the flood, but say dem send all the necessary information of how bad the flood go dey give all the states but dem no hear.
Adamu also blame pipo wey dey cut tree anyhow and spoil the soil for the serious impact of dis year floods for the country, but give assurance say that the present administration don already start work ontop flood management masterplan wey go take at least three years to finish.
Similarly so, the Minister of Works and Housing, Babatunde Fashola use soap and water wash Federal Government hand comot from say dem no provide temporary place for citizens wey dey vulnerable areas, as he tok say na states and local governments dat one concern.