Federal Government Go Share N25,000 Allowance To We Senior Pipo Of We Country. 

October 6, 2023

Federal Government don yan say dem go give special grant of N25,000 to help improve the lives of pensioners wey dey vulnerable for the country. The Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Dr. Betta Edu, talk this one as she meet with leaders of Nigerian Labour Congress (NLC) wey Mr. Joe Ajaero dey lead for Abuja. She talk say dem go share this money under the Conditional Cash Transfer (CCT) Scheme. She still yan say President Bola Tinubu don talk am say make dem make sure say vulnerable pensioners dey inside the National Social Register and dem go benefit from the CCT. She beg NLC make dem help make the process of gathering data for these pensioners go fast so that dem fit start to collect the CCT money.

More Posts