Federal Government Don Drag Ear Give Nigerians Say Make Dem Shine Eyes Against The Breakout Of Meningitis.

January 12, 2024

Federal Government don yan Nigerians about di increased risk of Cerebrospinal Meningitis (CSM) during dry season, wey fit carry dust, winds, and cold nights. Dem talk say for 2023, 190 people lose dia life to dis sickness.

Dem say make we shine our eye well as di weather fit bring upper respiratory tract infections wey fit increase di risk of infection, especially if plenty people dey one place and ventilation no dey good.

Di Director General of Nigeria Centre for Disease Control and Prevention (NCDC), Ifedayo Adetifa, talk say di highest burden of CSM for Nigeria dey for di “Meningitis Belt,” wey include all 19 states for Northern region, FCT, and some southern states like Bayelsa, Cross River, Delta, Ekiti, Ogun, Ondo, Osun.

Adetifa, for one public health adviser wey dem release on Thursday, come talk say government dey work to prevent, detect, and respond to cases of di sickness. E still talk say make citizens dey wash hand frequently with soap under running water or use hand sanitizers when e dey necessary.

More Posts