Federal Executive Council don approve N287.73 billion to do 14 road projects

February 5, 2025

Federal Executive Council don approve another N287.73 billion to take do 14 road projects for different parts of di kontri.

Afta di second day FEC meeting for Presidential Villa wey dey Abuja, Minister of Works, David Umahi, yarn say dis one no join di 10 road projects wey dem approve yesterday wey cost ₦885 billion.

Our tori pesin, Raliat Adenekan, report say di Minister still talk say di Council don step down di request to build permanent headquarters for Federal Roads Maintenance Agency (FERMA) so dem fit check am well.

On top im own side, Minister of Health and Social Welfare, Prof. Ali Pate, talk say FEC don approve ₦12 billion contract to install advanced diagnostic equipment for six teaching hospitals across di kontri.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/nlc-don-suspend-the-proposed-protest-over-the-telecom-tariff-hike/

More Posts