Dubai Govt Don Cancel Deir 30% Shayo Charges

January 3, 2023

The government of Dubai don cancel deir 30 per cent shayo charges so dem go fit better tourism for the emirate. Dubai go also pause the personal shayo license money, so dem go fit buy the permit free for pipo wey dey drink shayo for the United Arab Emirates area.

According to Arabian News, Dubai be one of the most cities wey pipo dey come visit for the UAE and even the whole world and the reason dem wan pause the shayo charge na to better the economy with more tourism. The latest development na one process wey the government make so dem go fit make the city more attractive to oyigbo visitors, and to take battle with dea Persian Gulf neighbor countries like Saudi Arabia and Qatar.

More Posts