Chad’s interim president, Mahamat Idriss Déby, don talk say he go run for this year presidential election. The political groups wey dey support am, wey dem call For a United Chad, endorse hin candidacy. Dem talk say dem get over 200 parties inside their coalition.
Dis announcement come just three days after the main rival wey Mahamat get for the election, Yaya Dillo, die for the capital N’Djamena under circumstances wey dey raise questions.
Mahamat Idriss Déby enter power for 2021 after the death of hin papa, Idriss Déby Itno, wey bin dey rule Chad for long. Idriss Déby Itno die for battle with rebels.
Mahamat talk say e go hand over to civilian government after 18 months but later on, e talk say e go extend am by two years.