At least 38 people don kpai and plenty odas wounjor for forest fires wey don chop parts of northern Algeria.
The country interior minister, Kamel Beldjoud tok say 24 people die for El Tarf, near the border with Tunisia, as well as one woman and her daughter for Setif.
Local media tok say at least 200 oda pipo suffer serious fire burn and respiratory problems.
Firefighters plus helicopters still dey find way to control the fire as at Thursday morning