Nigerian Army don carry responsibility for di air strike wey happun for Tudun Biri village for Kaduna State. Di Kaduna State Commissioner for Internal Security and Home Affairs, Samuel Aruwan, confirm di mata after one emergency security meeting. Earlier, dem talk say during di villagers Maulud celebration, an “unmanned aerial Drone” bomb some parts of di community, wey lead to di death of some pipo. For di emergency security meeting chaired by di Deputy Governor, Dr Hadiza Balarabe, di Army yarn say di bombing no be intentional but na accident as dem dey do routine mission against terrorists.
