Political temperature still dey high for Osun State as Governor Ademola Adeleke don secure another four years for office after INEC officially declare am winner of Saturday governorship election. But as PDP people dey pop champagne and dance βskelewuβ, APC never wan pack load go house as dem still dey check figures and dey weigh whether tribunal go be their next bus stop.
Adeleke carry 511,067 votes put for pocket, clear APC candidate Bola Oyebamiji wey gather 444,815 votes. The dancing governor sweep 19 local governments, while Oyebamiji manage hold ground for 11 LGAs.
As INEC announce result finish, President Bola Tinubu sharp-sharp hail Adeleke victory, talk say the outcome show say Osun people still trust am to continue steering the affairs of the state.
Tinubu even pick phone call am personally, congratulate am and advise make e no run government based on party colour, but make e carry everybody along whether dem vote PDP, APC or any other party.
According to the President, election season don pass, na time now for development, peace, job creation and better life for Osun citizens.
For him victory speech, Adeleke no come with gra-gra. Instead, him stretch hand of friendship give all him opponents and beg everybody make dem bury political beef.
The governor urge residents to forgive one another and stop any revenge mission after weeks of political tension, violence and sporadic gun attacks wey rock different communities before election day.
Adeleke promise say him second tenure go sweet pass the first one as him go strengthen areas wey work and repair where government miss road.
Him assure Osun people say more roads, infrastructure, investments, jobs and people-oriented projects dey loaded inside him renewed five-point agenda.
The governor still thank Osun people, democracy supporters, media houses and President Tinubu for helping ensure say the election remain peaceful and credible.
As e dey talk, Adeleke once again publicly back Tinubu for second term come 2027, saying the President na true son of Osun State. Even though APC chop defeat for the poll, the party say dem never throw in towel.
According to party spokesman, Kola Olabisi, election no dey finish until every legal avenue don exhaust, from tribunal go Appeal Court and even Supreme Court if need arise.
The party reveal say lawyers and top stakeholders dey currently comb through results from all 332 wards across the state before dem decide their next line of action.
APC still beg supporters make dem cool temper, avoid violence and no answer any provocation from political opponents while consultations dey go on.
Dem insist say challenging election result through legal process na part of democracy and promise say any action wey dem take go remain inside the four corners of the law.
African Democratic Congress (ADC) congratulate Adeleke for him victory but still raise alarm over one development wey happen during result collation.
The party claim say upload of polling unit results to INEC IReV portal suddenly stop for almost four hours during election night when APC still dey behind.
ADC National Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, say Nigerians deserve explanation from INEC on top the matter to avoid suspicion and restore public confidence.
Although ADC no provide evidence say anybody deliberately stop the upload, the party insist say INEC must explain wetin really happen.
Despite the complaint, ADC agree say Adeleke victory show say voters fit resist pressure, inducement and heavy political machinery when dem make up their mind.
The party also talk say the election prove say opposition alliance fit become serious force ahead of the 2027 general elections.
ADC governorship candidate, Najeem Salaam, wey finish third with 17,180 votes, don congratulate Adeleke and call on everybody to respect the voice of the electorate.
Salaam advise Adeleke make him use the fresh mandate to correct areas where government underperform, consolidate achievements and deliver more dividends of democracy to the people.
As victory songs still dey loud for Osogbo and other parts of the state, political observers dey watch closely to see whether APC go finally carry the matter enter tribunal or quietly accept the outcome and prepare for another day.
One thing sure be say β Osun election fit don finish for ballot box, but political drama never completely close curtain.




