Zimbabwe don introduce one new currency wey dem call ZiG – di name stand for “Zimbabwe Gold”.
Dis na di latest attempt to stabilize dia economy.
When dem reveal di new money, di central bank governor John Mushayavanhu talk say ZiG go get structure, and di exchange rate go be based on market determination.
ZiG dey replace Zimbabwe dollar, wey be RTGS, wey don lose three-quarters of im value so far dis year.
Zimbabweans get 21 days to change dia old, wey inflation don spoil, notes for di new currency.
But, di US dollar, wey dey account for 85% of transactions, go still dey legal tender.