24 June 2025,
“I lose two sons and oda relatives because of dis wicked act by mob, my husband leave me with 13 children”.
Na so Faji Sani, wey lose her pikin, husband and oda relatives for di attack on travellers for Plateau state tok. Mrs Sani dey ask di govment for justice and compensation.
Di recent killing wey happun for Mangu Local Government Area of Plateau State, North central Nigeria wia mob kill some travellers, don cause serious reactions in di kontri.
Di victims bin dey travel from Zaria for Kaduna State on Saturday to go attend wedding for Qua’an Pan Local Government Area of Plateau State, wen mob intercept dem for Mangun district.
Some of di travellers die for di scene, while odas sustain different kaind injury, and dem dey hospital now for treatment.
Authorities for Nigeria say about 13 pipo die afta some pipo ambush one bus wey belong to Ahmadu Bello University for Zaria.
Kaduna State Govnor, Senator Uba Sani, don condemn di killing as e describe di attack as “wicked and senseless” and e insist say dis kain tin no suppose go free witout punishment.
“No reason dey to attack any Nigerian for any part of di country” di govnor tell BBC Hausa.
“Dis kain wickedness suppose make everibodi vex, and dem must find dos wey do am and deal with dem well.”
Govnor Sani tell im counterpart for Plateau State, Govnor Caleb Mutfwang, make e act, join hand wit security pipo so justice go happun.
“I go follow di investigation myself. We must show say impunity no go dey allowed again” im add.
President Bola Tinubu wey also condemn di killing say di attack dey “unacceptable and barbaric.”
E don also order all security agencies make dem catch di pipo wey do am and carry dem go face justice.
“Freedom to waka anywia for Nigeria na right wey nobodi fit collect. We no go allow anybody or any group use violence or fear try stop citizens from moving freely.”
Dis recent attack on travellers for Plateau state don bring up di tok about di safety of travellers for Nigerian roads, as e no be di first time e dey hapun.
Dis attack dey come months after anoda attack on travellers for Edo State, for southern Nigeria, wia mob kill some travellers – hunters – wey bin dey travel to Kano for northern Nigeria through Uromi.
For 2018, one Nigerian Army officer wey be former Chief of Administration, Major General Mohammed Idris Alkali (rtd), go missing wen e dey travel from Abuja go Bauchi. Later dem find im dead bodi for Plateau State, according to reports.
Wetin dey worrying now be say apart from bandits wey dey kidnap or kill pipo for road, if person dey travel for road, e fit still fall victim of mob lynching for Nigerian highways.
Credit: BBC NEWS