W.H.O Don Carry Microphone Yarn Us Say Dem Don Increase Dea Partnership To Take Better Dea Way To COVID-19 Science.

August 30, 2023


World Health Organisation (WHO) don yan say dem don expand partnership to help pipo get better access to COVID-19 technology, knowledge, and clinical data. Dem talk say e dey important make we still dey fight against the virus. This partnership wey dem call COVID-19 Technology Access Pool (C-TAP), dem start am for 2020. E dey help to make sure say pipo fit get COVID-19 health products wey dem need for time, wey go dey fair, and wey dem go fit afford, through agreements wey dey focused on public health, transparent, and wey no dey exclusive.

Di three groups wey don join C-TAP na di private vaccine manufacturer wey be Medigen Vaccine Biologics Corp, Spanish National Research Council, and University of Chile.

As of August 16, 2023, globally, dem don confirm over 769 million cases of COVID-19, wey include 6.95 million deaths. Dem don also give almost 13.5 billion vaccine doses.

More Posts