Voting for US Midterms Don Start

November 11, 2022

Pipo for round US don dey cast deir votes for the midterm elections to know who go control congress. For the last two years now, the Democrats don dey control the two chambers- the House of Representatives and the Senate. Eh be like say the Republicans go take the House while Senate dey very important situation and too close to call. If dem lose any of the chamber, eh go delay the agenda of Democratic President Joe Biden. Dem also get state-level elections wey fit mean say new abortion laws go dey for some states. Meanwhile, Donald Trump don give small idea say hin fit carry mic next week say hin dey run for president again for 2024.

More Posts