Uganda National Drug Authority don gree say dem bin know one HIV medicine wey pipo dey use fatten up animals for 2014 but dem no come out drag ear give the public pipo. The Authority senior drug inspector Amos Atumanya yarn the lawmakers for the country say dem don know of one drug wey dey fight against HIV wey pipo con dey use take treat pigs and chickens, and if we humans chop small amount of the drug for dea food e fit dey dangerous. As one spokesman bin tok say if any health danger dey, dem for don come out since tey-tey to drag ear give the pipo, while NDA job na to control drugs and not human food or animal feed. The NDA report for 2014, don see say pipo dey use the drugs against HIV to take treat mostly African pig fever wey we also know as Pig Ebola and right now e no get any cure.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905