President Bola Tinubu don make am clear say e no get any plan to commot for Aso Rock in 2027 without fight, as e declare say anybody wey wan collect presidency from am go need prepare for serious political wrestling till the final whistle.

Tinubu yarn dis one on Tuesday when members of the Catholic Bishops’ Conference of Nigeria (CBCN), led by dia president, Most Rev. Matthew Ndagoso, visit am for State House, Abuja.

As dem raise concern about whether INEC go remain neutral for future elections, Tinubu quickly dismiss am, insisting say electoral commission never intimidate any political party.

The president talk say

Na me ask Nigerians make dem give me dis work, and I dey do am. Anybody wey wan collect am from my hand fit try, but e no go easy. Politics na equal opportunity game.

INEC neutral well well. Dem never threaten anybody. If some opposition people dey cry say danger dey, maybe na because dem dey fear dia own shadows and the people wey dem dey follow, no be because of me.

I ready for the battle, but I no go spread red carpet for anybody. I no go give dem rope make dem tie my hand. Lai lai! We go wrestle till the final point.”

The President still use the opportunity defend the performance of im administration, saying despite the plenty wahala wey e inherit when e enter office, life for Nigerians dey gradually improve.

Tinubu point say stability for universities as one of the achievements of im government, noting say ASUU strike wey don become regular headache before no dey disturb students again.

Quality of life dey improve. Our founding fathers do dia best, and we owe future generations better Nigeria.

Today, university students dey stay for school. Four-year course dey remain four years. ASUU no dey strike. Dem no dey bring suffering come families again. To me, na answer to prayer be dat.

The President admit say challenges still plenty for the country but insist say e no run away from the problems wey e meet for ground when e assume office.

The challenges dey. Na so I meet am. But I no run away from am, Tinubu conclude

FOR MORE TORI