The Lagos State Government don yan say make people dey extra careful and make dem take precautionary measures as di state dey record outbreak of cholera.
Di State Commissioner for Health, Prof. Akin Abayomi, for one statement, don warn say di state don record plenty plenty cases of severe gastroenteritis for di last 48 hours for communities around Eti-Osa, Lagos Island, Ikorodu, and Kosofe Local Government Area of di state. E don lead to about 60 hospital admissions, and five deaths from patients wey show up late but dey suffer from extreme dehydration.
Di commissioner talk say afta di recent rainfall, Lagos don see plenty cases of severe vomiting and watery stool, especially for urban slums and areas wey get poor sanitation.
E still advise residents to report any suspected cases through emergency hotlines: 08023169485, 08137412348, or by using helplines 767 or 112.
For more news https://naija102.com/blog/