Di negotiations wey dey go on for di new minimum wage don nack wall as di Federal Government and organized labor no fit gree on top any mata.
Mr. Bayo Onanuga, wey be di President media aide, criticise workers wey dey insist on top N615,000 minimum wage, talk say no agreement don happun between government and labor unions regarding di amount.
But Joe Ajaero, wey be di President of di Nigeria Labour Congress, defend workers’ demand, yan say organized labor no go gree for any amount wey go make dia members suffer.
Officials from di Federal Ministry of Labour and Employment, wey yan on di condition of anonymity, reveal say government and di private sector dey propose minimum wage between N60,000 and N70,000, and dis na wetin cause di gbege for di negotiations with labor.