Super Eagles Trainer Jose Peserio Don Drop 27-Man List For Friendlies.

October 3, 2023

Super Eagles head coach Jose Santos Peseiro don call up 27 players for the international friendlies wey dem get against Saudi Arabia and Mozambique for Portugal this month. Players like Kenneth Omeruo, Bright Osayi-Samuel, Alex Iwobi, and Terem Moffi wey no dey for the team wey flog Sao Tome and Principe for the 2023 AFCON qualifier for Uyo last month don enter this list.

Super Eagles go play the Green Falcons of Saudi Arabia on the 13th of October for Portimao, Portugal, and three days later, dem go play against Mozambique. All the players wey dem call up go dey Faro, Portugal, for the matches.

More Posts