South Africa health ministry don talk say second person don die this week from the viral infection mpox, less than 24 hours after dem announce the first death.
Mpox, wey dem before dey call Monkeypox, na viral illness wey dey spread through close contact with infected humans or animals, and through materials like contaminated sheets.
For July 2022, World Health Organization (WHO) declare Mpox as global health emergency wey last for 10 months.
South Africa government talk say the second person wey die na 38-year-old man wey dem admit for hospital for KwaZulu-Natal (KZN) province with extensive lesions, headache, fatigue, oral ulcers, muscle pain, and sore throat.
Dem test am positive for mpox on Wednesday.
For more news https://naija102.com/inec-don-unveil-candidates-list-for-ondo-state-election-campaign-go-begin-june-19/