Members of Somalia National Consultative Council don agree to continue with one serious military attack against di al-Qaeda-affiliated al-Shabab militant group wey start for August last year. Di council wey join together di leaders from di federal government and di regional states, gather to discuss how dem go take fight against di group.
According to wetin di presidency publish for X (wey be di former Twitter), di leaders don agree to work together for di military attack and “align am with di national counter-terrorism strategy” to end di group long-time insurgency. Dem talk say dem go set up “one joint command structure” to dey manage di military operations against di militants.