
Article Information
Kenya President William Ruto don order police to shoot protesters for leg wey dey target businesses, e tell police say make dem no kill dem but wound dem.
UN and human rights groups bin accuse di police of using too much force for di recent wave of anti-goment protests – 31 die on Monday, according to one join body for di state.
Di president say “Anybody wey we catch dey burn anoda pesin business or property police go shoot dia leg, dem go carry dem go hospital, and later take dem to court. No kill dem, but ensure say you break dia legs,” di president tok.
Im also warn im political rivals against sponsoring and using violent protests and “unlawful” means to forcibly remove am from power.
In addition to di 31 deaths, more dan 100 pipo wunjure and about 532 chop arrest for di the protests wey happun for di capital Nairobi and oda major cities, na wetin Kenya National Commission on Human Rights (KNCHR) tok.
Kenya police say 11 pipo die.
Di UN say dem dey troubled by di killings and dem criticise di Kenyan police for using “lethal ammunition” against protesters.
But for one address on Wednesday, Ruto defend di police action, e say attack on security forces na “declaration of war” against di kontri.
“Kenya no fit and no go dey ruled through threats, terror, or chaos. No be under my watch,” di president tok, e vow to “firmly” deal wit those wey dey behind di protests.
Im say any change of goment go only dey possible through di ballot and no be through protests, im tell im opponents to wait for di 2027 general elections.
“Few pipo wey dey impatient wey wan use unconstitutional means no fit destroy dis kontri. E no go happen,” Ruto add.
Former Deputy President Rigathi Gachagua, don deny claims say di opposition dey plan to overthrow Ruto from power.
“Nobody wan remove you out of goment unconstitutionally. We wan face you for ballot for August 2027, so just relax,” na wetin di former VP, wey dem bin impeach last year afta im bin fall out wit Ruto.
Tension don dey rise for di kontri since di death of one blogger Albert Ojwang for police custody last month.
Dis incident make pipo enta streets again one year afta young protesters bin storm parliament angered by a wave of tax rises.
Rising economic challenges dey make pipo vex for di kontri wey youth unemployment and di quality of jobs na serious concern.
Ruto gree say youth unemployment na big wahala for di kontri but im say di job challenges don dey since bifor im come to power for 2022. Im say im administration na di first to take deliberate steps to address di mata.
Di 58-year-old leader kwesion why some Kenyans dey more critical and confrontational towards im administration compared to previous goments.
“Why una dey cause all dis wahala for my time? Ruto ask, e warn against ethnic politics.
“You fit call me any name you want call me, but I go make sure say peace and stability dey Kenya.”
Di plan for Monday protests na to celebrate Kenya decades-long struggle for democracy but sharp- sharp e change into deadly clashes for 17 out of di kontri 47 counties, local media report.
Many of di pipo wey do di I-no-go-gree waka bin dey shout “Ruto must go” and “wantam”, wey mean “one term”, na popular rallying call to demand make President Ruto leave office.
For one statement wey come out late Tuesday, di KNCHR say di sharp rise for di death toll dey “deeply troubling”.
“Di KNCHR strongly condemn all human rights violations and dem ask for accountability from all responsible parties, including police, civilians and all oda stakeholders,” e add.
Di commission also document widespread looting and destruction of both public and private property by unidentified individuals.
Among those wey dem kill na one 12-year-old student wey stray bullet hit for im house for Kiambu, wey dey di outskirts of di capital, na wetin local media report.
“E dey very concerning say these latest incidents dey come barely two weeks afta more dan 15 protesters die and many more injure for Nairobi and oda parts of Kenya on 25 June,” na wetin Ravina Shamdasani, di tok-tok pesin for di UN High Commissioner for Human Rights.
“Lethal ammunition, rubber bullets, tear gas, and water cannons na dem use,” Shamdasani add put.
At least two hospitals bin dey damaged afta unidentified attackers raid di facilities and steal medical equipment and harassed staff, Reuters news agency report.
Religious and rights groups don demand for a prompt and independent investigation into di killings, destruction of property and arbitrary arrests.
Opposition leaders on Tuesday bin accuse di goment of deploying unmarked police vehicles to transport armed gangs to perceived opposition strongholds during di protests.
Dem call for a national boycott of all businesses wey dey affiliated wit President Ruto administration, dem accuse im goment of deploying state-sponsored violence and extrajudicial killings on Kenyans.
“Dis regime dey hostile. You no fit reasoned wit dem. We must resist dem. We no go rest. We no go stop. We no go surrender,” di opposition t ok for inside joint statement.
Kenya Chief Justice Martha Koome don warn di kontri against di increasingly violent protests, dem say na risk to di nation democratic fabric.