By Raliat Adenekan
Vice President Kashim Shettima don talk say di present administration don make serious progress to stabilise di economy, as inflation dey calm down, naira dey stable, and investors dey show more interest for Nigeria.
Senator Shettima wey represent President Tinubu for di PGF–Renewed Hope Ambassadors Strategic Summit for Abuja, say na di reforms wey government put in place cause di improvement. According to am, di naira strong and stable, and di Central Bank of Nigeria interventions dey help keep di market balanced.
Shettima still talk say government dey prepare to move faster for 2026, wit ₦58.18 trillion budget wey get record capital expenditure and careful revenue projections.
Di Vice President come charge di Renewed Hope Ambassadors make dem take civic engagement serious and carry di message of national rebirth go every corner of di country.
Our correspondent, Raliat Adenekan report say while di Vice President dey talk about di situation for Benue State, e stress di need for reconciliation and unity among party leaders, tell dem make dem settle their differences and move di state forward.
Chairman of di Progressive Governors Forum and Director-General of di Renewed Hope Ambassadors, Governor Hope Uzodinma of Imo State, praise President Tinubu for di economic reforms. E say stakeholders dey on ground to unite di APC structure and make di party stronger and more united.
National Chairman of di All Progressives Congress (APC), Prof. Nentawe Yilwatda, talk say better communication important well well. E regret say despite plenty infrastructure projects wey Tinubu administration and state governments don deliver, people no really see di achievements because communication no strong enough.




