Nigeria Senate don reply Senator Natasha Akpoti-Uduaghan complaint wey she carry go United Nations Inter-Parliamentary Conference for New York. Di reply come through one letter wey Senate Leader, Senator Opeyemi Bamidele, write.
Di Kogi lawmaker bin carry her case go meet di global body make dem help am fight wetin she call injustice wey dem do to her.
But for di letter wey Honourable Kafilat Ogbara—wey be Chairperson of di House of Reps Committee on Women Affairs and Social Development—read for di conference as Nigeria representative, di Senate explain say dem suspend Senator Natasha because of her continuous gross misconduct, lack of respect for Senate Standing Orders, and unruly behavior. Dem talk say e no get anything to do with di sexual harassment or assault allegation.
Honourable Ogbara still add say di Senate follow due process before dem suspend Senator Natasha, but she also call for better investigation into di allegation wey Natasha put for Senate President, Godswill Akpabio head.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/house-of-reps-don-talk-say-make-dem-ban-new-atm-charges-ban-pornographic-websites/