Senate Burst Fake Tori Say Dem Wan Create New State

July 23, 2025

Senate Presido Godswill Akpabio don comot tok on Tuesday say all di gist wey dey fly for social media say National Assembly don approve new states na pure lie, e no happen.

As dem dey do plenary, Senator Abdul Ningi raise matter and Akpabio reply say dem don collect over 42 proposals wey suggest creation of new states, but none don pass di wahala legislative process wey Constitution require.

“I don see more than 42 proposals, but not even one don reach final discussion. To create new state no be beans, na serious process wey nobody don complete yet,” na wetin Akpabio yarn.

He still warn communities make dem no dey gather people or do mobilisation for states wey never exist on paper. E stress say Senate never approve any new state at all.

The Senate Presido don beg Nigerians make dem no dey carry social media rumour for head. He tok say anything wey concern constitution amendment or new law, na only official statement from National Assembly people go fit confirm wetin dey real.

Meanwhile, di Senate don fix special session for Wednesday to honour late former President Muhammadu Buhari. For di gathering, lawmakers go reason wetin Buhari contribute to Nigeria development, both for him time as military ruler and elected presido.

More Posts