Rescue operations dey go on as explosion nack Ibadan, and many people dey fear say some go don wound.

January 17, 2024

Panic waka enter Ibadan, Oyo State, as loud explosion happen around 8:00 pm, and buildings begin collapse because of serious vibration.

Oyo State Government don talk say na “an uncommon explosion” happen, and people dey speculate say houses and cars wey far from the place feel the impact of the blast wave.

As e be, we no fit confirm the number of people wey wound for now, but we hear say dem don rush victims go hospital. Some people sef dey trapped inside buildings wey collapse because of the blast.

The Commissioner for Information and Orientation for the state, Prince Dotun Oyelade, don confirm the matter. He talk say people get different talk about wetin happen, but he yarn say the State Government dey fully in control with security people including paramilitary to handle the situation.

Governor Seyi Makinde don yan say make people relax and make dem know say the government dey take care of their matter.

More Posts