President Tinubu Don Write Give National Assembly, Dey Find Go-Ahead of 500bn To Take Provide Help For We Country Pipo.

July 13, 2023

President Tinubu don beg NATIONAL ASSEMBLY make dem approve N500 billion so federal government fit provide PALLIATIVES wey go reduce the wahala wey go happen as dem remove petrol subsidy.

The President send letter go National Assembly, and Speaker of the House, Tajudeen Abbas, read am during plenary yesterday. The letter talk say make dem change the 2022 Supplementary Appropriate Act.

For December, national assembly don pass supplementary budget of N819 billion for 2022 fiscal year..

More Posts