President Bola Tinubu don swear in Retired Vice Admiral Ibok-Étè Ibas as di sole administrator for Rivers State.
As Ibas talk to tori people for State House after dem swear am in yesterday, im promise say im go work with all di people wey get stake for di mata to make sure say law and order dey Rivers State.
Dis one happen less than 24 hours afta President Tinubu declare state of emergency for Rivers State, come suspend Governor Siminalayi Fubara, im deputy Ngozi Odu, and all di members of di Rivers State House of Assembly for six months first.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/president-tinubu-don-declare-state-of-emergency-for-rivers-state-e-suspend-gov-fubara-him-deputy-plus-assembly-members/