President Tinubu don suspend Betta Edu and e talk say make EFCC investigate di Humanitarian Ministry.

January 9, 2024

President Tinubu don order di immediate suspension of Dr. Betta Edu as Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation. For one press statement wey Ajuri Ngelale, Special Adviser to di President on Media and Publicity, issue yesterday, e talk say di President don also instruct di EFCC Executive Chairman to investigate all di financial transactions wey concern di Ministry and other agencies wey dey under am. Dem also yan say make Dr. Betta Edu hand over to di Permanent Secretary of her Ministry. As EFCC don invite her, she dey go answer questions for dia Abuja headquarters.

More Posts