Presidency don talk say dem no go commot any agencies for tax reform

President Tinubu don promise say e go use sense take bring Mali, Niger, and Burkina Faso back to ECOWAS

December 12, 2024

President Bola Ahmed Tinubu don talk say di welfare and interest of di people for Mali, Burkina Faso, and Niger still dey priority for ECOWAS leaders. E assure say na wisdom and diplomacy go help reintegrate di countries back to di regional body.

President Tinubu, wey be ECOWAS Chairman, talk dis one yesterday when im receive di German President, Frank-Walter Steinmeier, for State Visit inside di Presidential Villa for Abuja. Tinubu yarn say di leaders of di three countries never gree bring out transition programmes with clear dates, but ECOWAS go still leave di door open for di return of democracy for dia.

Our correspondent, Raliat Adenekan, report say Tinubu still pledge to strengthen di partnership between Nigeria and Germany, especially for energy and economic development sectors.

On im part, di German President praise di ongoing economic reforms for Nigeria and talk say di reintegration of di three countries go help improve di economy and security for West Africa.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/tinubu-don-open-nigeria-immigration-service-technology-innovation-complex/

More Posts